Thursday, December 01, 2005

THE FUTURE OF NAIJA...


tomorrow be like woman
wei get belle
nobody fit sabi wetin
she go born
forget scanning

tomorrow sef be like river
wei dey flow without end
e dey kom dey go
like NEPA for Naija

every day we go dey hope say
tomorrow go beta
but wen e kom,
him cold like dog nose

de tomorrow wen we talk yestaday
don bekom today

tomorrow, e dey kom sef?

but dis na de tomorrow
wen we talk about yestaday ke!

Tufiakpa! see as him black
like midnight
and de song wei him dey sing
skatter like sakato

dis tomorrow get as e bi o!
e go fit beta so o?

oya, kom make we pray...

No comments: